01-08-2018, 10:53 PM
|
|
Confirmed User
Industry Role:
Join Date: Sep 2015
Posts: 1,045
|
Woman wan troway poo-poo, come trap for window
BBC Pidgin -
Woman wan troway poo-poo, come trap for window
https://www.bbc.com/pidgin/tori-41171196
Quote:
Woman wey take her hand, pack her poo-poo comot di toilet of man wey she dey friend because ''e no gree flush'' enter trouble, after she go try collect di poo-poo back.
The woman wey dey learn gymnastics, just start to waka with Bristol student, Liam Smith, for di first time, when she take fear troway di poo-poo comot for window.
Instead make di thing land for garden, di poo-poo come jam between two windows wey no dey open wide.
Di lady decide to carry her thing back; she use head enter the small space wey di poo-poo bin dey, but na so she come trap for there, and trouble start.
Mr Smith say im no get choice but to call fire service make dem help remove di girl, along with her poo-poo.
Now, im don dey try raise money to repair di windows wey break, so e write all di tori for inside one University of Bristol crowd funding page.
|
|
|
|